Saturday, June 2, 2007

What the Enemies did to Laspapi's Name

Laspapi na winch o. Im put me live for the Laspapi -ovation Times newspaper front page, na instantly wey i become the first and only celebrity blogger in naija... the visitors book for my office don full sef pass the visitors book for the presidential office... Laspapi, I salute una o. Thank you for de honor wey una do me o.

In reciprocation of de goodwill na im i say make i slot laspapi name into the presidential list of nominees for political appointment aka "come-and-eat-and-clean-mouth-and-go-away". I recommend Laspapi to President Yar'Adua for the position of "Acting Deputy Senior Special Assistant to the President on Celtel phone calls, yahoomail, and Hi5 matters". The occupier of dis position na im work to dey carry the calls wey enta the Presidential Celtel line, to dey open the presidential yahoo mail, and to dey maintain the presidential profile on Hi5. Na powerful position o, i tell you.

But, i no know say ota po ju enemy lo... (opponent plenty pass enemy). By the time de list dey reach national assembly for discussion, somebody don do magic substitute laspapi name comot de list.

Chei, people wicked o! i no know who substitute dat name comot. e pain me o. de way we dey tamper with list for this naija i tire o. na monkey go win governosrship primaries na baboon go come contest election. na one person go do interview, pass, na another person go come resume job. Na boli go do work till month end, na epa go come collect salary!

Na Mr. A kill Bola Ige, na Mr B. Ehindero go parade for NTA say na de murderer be dat. (Btw Ehindero for kuku tell us say na dat same drug baron kill Alfred Rewane, Dikibo, Dele Giwa, Funso Williams, Dr. Daramola, Harry Marshal, etc etc)

U hia de tori of the naija football team (under-21 abi na under-19) wey go soccer competition for Israel? After dem don win competition finish na im all of dem find their levels o; enta jerusalem and gaza strip and west bank and bethlehem in search of pastures greener than a soccer pitch. The whole team o, plus including coach. dem miss completely. Na im another set of naija players wey also don collect israel visa quickly enter Jerusalem from Lagos to COLLECT the Cup. As those ones too collect cup finish, na im dem sef miss for israel o... the stupid israel people no know say no be de same team wey win competition wey collect cup...

na dat same way wey sunny ade and KWAM 1 and Obey band dey miss for european tour... imagine, the poor musician go carry complete band enta europe for band, but when showtime come, na soundtrack im go use sing because all im boys don wave comot... na full band dem go carry go, na only instrument and band leader go take return flight to naija

16 comments:

laspapi said...

"Na Mr. A kill Bola Ige, na Mr B. Ehindero go parade for NTA say na de murderer be dat. (Btw Ehindero for kuku tell us say na dat same drug baron kill Alfred Rewane, Dikibo, Dele Giwa, Funso Williams, Dr. Daramola, Harry Marshal, etc etc)"- This is the story of our country.

Thank you for the nomination for special adviser, General, it's the thought that counts. Even if dem hide my nomination paper today, d paper go show face tomorrow

Unknown said...

Oh my goodness... this is too funny, but on a more serious note. Isn't it sad that Naija people miss in their host countries when they have been issued visas to perform a specific function abroad. It says a lot about the state of the nation. Someone was telling me about a pastor who was denied an American visa because the last time he was in the country his associate pastors who accompanied him melted into the crowd and did not return.

36 INCHES OF BROWN LEGS said...

as my brother will say ' if u choose to die for NIgeria, u go just die, noring go happen!!!!

Ms. Catwalq said...

OH LAWD!!! Blogger General!!!! I no know wetin I fit call u at this point. Where u take hia say our boys dey fly border escape to greener pastures? I no talk say u dey lie o, I just dey wonda where u dey take obtain all ur info. Poor KSA. O ma se o.
Keep it up?
Who is Laspapi sef?

Anonymous said...

pls check out my page or miss okpeke's page on the upcoming blogville idol contest...Will u be interested?pls say yes!we just trying to spice up stuff on blogville.... anybody else reading this check it out too

vindication through innocence said...

sniffing gari is not bounz o!!!this is soo funny!

Unknown said...

e ka bo sori eto o. nice blog o. very funny too. do u want 2 overthrow baba alaye ni? d coup 'll be serious o. abeg kip up d humour o, it's needed 2 kill stress. me too m looking 4 job o so if u find.. later

BlogVille Idol said...

HEY PEOPLE..THE BLOGVILLE IDOL CONTEST HAS STARTED GO TO OUR PAGE AND LISTEN VIA THE VOICE PLAYER and VOTE FOR YOUR FAVORITE CONTESTANt VIA THE VOTING POLL..PLS SPREAD THE WORD

Omolola said...

loll.seriously naija na bad place.if u never comot 4 here b4 omo if u just go yonder once u no go wan come back.ever looked out frm a plane when leaving heathrow...everywhere just fine,b like LEGO.Enter naija ,u no go wan come down from the plane ooo.....everywhere just black b like hell.omo this country bad gaaaan!!!xxx

My Pen My Paper said...

O boy, u be bad boy o. How you come know say all the under-whatever players miss for Israel. See, after the real football, then most important football just starts. Don't worry, give those our boys 10-20years after dissolving into Israel. Nigeria will start inviting their children to come and join the national-team. Abi, what goes around comes around. anyhow, anyhow

Blogger-General of the Federal Republic of Nigeria said...

@laspapi - AMEN!!!
@Jola Naibi - na true o, even pastor sef...
@36 inshes - i love America i no go die, na inside am i go live and lie
@catwalq - u suppose cover ya eyes in shame... una nor know LASPAPI - www.laspapi.blogspot.com
@ pinksatin - u wan make i sing... i no sure i go fit o... i be civil servant...
@vindication - thanks.. more consolidation
@labake - e se o... Asari Dokubo dey find young recruits o.. u don see de advert?
@idols: tanks, i go show face
@omolola - I like dat lego part, LAWL
@omo nigeria - soon Super eagles go full of half-caste

Anonymous said...

lma. ur a joker... unserious human being that u r.. i loved this.. come which one come by my own position now.. shebi u promised me something...

SOLOMONSYDELLE said...

hahaha
Hillarity.

A whole bunch of half caste super eagles? Chei, na wa for Naija!

Ms. Catwalq said...

o boy na wah o.
where u dey, u suppose don update now, wetin.
abi dem sack u? nepa off light, u no fit blog? ur landlord take ransom u for im past due rent?
see i don give u like three topics to talk about if the thing dey hard you...

Mr.Fineboy said...

Blogger-general update now! Abi Ribadu don carry u?

Babawilly said...

Blogger-General, I don see say di pidgin done well for yua pen and it cook nearly burn for yua keyboard. No shakin. I enjoi yua post. E sweet laik say Oprah Winfrey send mi Moneygram and western Union at same time on christmas day.
Will be looking out for more posts.
God bless