Wednesday, May 30, 2007

Are Idols are not from West Africa?

Idols. West Africa. Before nko?
Finally, baba God don deliver all our bloggers from the power of orisa (idols). I don dey fast dey pray since say make Almighty God and Holy Spirit do generational deliverance for dis our idol-worshipping generation.
When i see handsome guys and handsome gal dey chase Idol like say na from village dem dey remote dem, fear catch me for dis generation. Everywhere person turn, na idol. I come confuse. Wetin dey responsible for the emergence of Sango, Eshu, Obatala, etc etc for dis blackberry, ipod age.

De time wey I first hia idol, I dey wonder. Sango don get reality show for DSTV? As I come no get DSTV now (I neva become Blogger-General dat time) I no understan’ de ting. De last time I hia anything about Sango, Amadioha and co na dat time wey Baba ex-presido appoint plane-dropping Borishade as Minister of Culture.
Immediately the appointment enter news naim the gods carry placard go Aso Rock say make Baba comot Borishade from their ministry. Dem dey fear say, as Borishade dey drop plane, naim im go take carry im bad luck come the council of the gods. So dem carry the placard go Aso Villa, but Baba and Atiku dey fight dat time, so baba no get time.
I bin tink say the gods go resign their position. Hope come dey for my jobless soul say I go fit send application:
Application for the Position of god of women and money:

Dear Eledumare/Chukwu

In reference to the resignation of the following gods: Sango, Ogun, Obatala, Amadioha and Eshu, I hereby humbly apply to be considered as a replacement for any one of them. Or better still, you may use your good office to create a new portfolio for me: god of women, wine and money. I will not disappoint you Sir. I will be the first god to have an email address, amongst many other things.

Yours truly,
Me.

oh boy, I gatto run now, meeting dey with the new Presido dis momo. Catch ya larer. Gist dey o...

2 comments:

laspapi said...

You're a mental case, blogger general, but i enjoyed this. The gods went to Aso rock to complain about the plane-dropping aborishade?

And you thought Sango had started a reality show on DSTV? hehehe!

Ms. Catwalq said...

Silly!!!!
Wait oh, what if they respond to your application?
Or Sango dem say that u were trying to fap their job?